Wida You Crooner Abobi Eddieroll Wrote;
"Some people funny sha..
Because dem no do confirm for you..u no fit hype person show
We no get love for ourselves..
Short story..
At first I started as a producer...
I go make beats for different artistes for free.. These artistes go collect beat.. To record d song na problem.. To drop the song after recording..na another problem..
How producer wan carry blow?
So for that reason.. I decided to record on my beats..
I come dey drop songs...
Luckily for me.. My first single "WIDA YOU" went viral by d grace of God..
Another problem come Start.. To see show perform na problem.. Sometimes dem go put my face for banner.. When I reach d venue.. The organisers no go allow me perform..
Some shows sef.. I go dey beg to perform..
Some shows na me dey use my own money transport myself reach d show even pay hotel room for myself..
All that one to me.. Na dues I dey pay as artiste..
E bad reach where.. My song dey reign.. Yet people dey call me with 5k for show.. Some I dey close eye go run am because I need show myself at some point
After some time.. I realise say nobody go help you..if u no help yourself..
So since dem no wan dey allow me dey perform for their shows..
I decided to do a show for myself n other acts like me wey no dey see show because of the Wicked, self-centered, selfish and arrogant so-called A-list artistes wey we get for this side wey dey feel say dem don blow (Tho i know say all of us na still upcoming)
Now some dey carry akpor..dey talk shit.. Dey send me careless messages... Some even say I disrespect Dem by not including their faces n names for my banner.. So for that reason Dem no go show love..
Una no gree use my beats... I go use all of dem..
una no gree gimme shows.. I go create my own stage perform to my own fans..
No time to worry about irrelevant things and humans..
People wey know me know say i dey try for myself n d artistes wey dey around me..
So friends n folks.. Do well to show me Love...
Keep a date with me on the 25th of JULY
Let's go turn up together in NDU...
Let Love Lead..
Stay peaceful..
Stay Blessed..
Abobi'Jammaker...!!!"




