Wida You Crooner Abobi Eddieroll wrote; 

“Hey guys... 
Omo Abobi dey bring something wey una go carry get hope dey hustle... 

No matter wetin u dey do.. No matter how small d thing u dey do
Whether na 500 u dey make a day, or 2k for a week.. 

The Good news be say.. 
LAS LAS... 
YOU GO PILL OUT.. 

Bayelsa Artistes this
Bayelsa Artistes that.. 
We no dey make millions yet, 
Las Las.. With or without Una help.. 
Boys go still Pill Out.. 

You support.. We win 
You no support.. We still gon' win... 
Pilling out is a Must. 

Everybody don turn comedian and Bayelsa Artistes don turn Una jokes. 
We no go answer Una after all we all dey d same boat.. 
Boat sink.. Who no sabi swim nai go drown... 
Instead of downloading our songs or hype those of us that r trying.. 
Una go come here dey type bullshit... 
Instead of coming here to type shit about Bayelsa Artistes, use that mb go download Porn... 
Because whether u like it or not.. 
Our work go speak for us and Las Las.. 
We go PILL OUT main main 
That time.. 
Na Una go still come beg us.. And we go give cos we no go allow Una infect us with Una disease of hatred...

#PILLOUT
Dropping soon... 

Visuals by Bobby Rak
#AbobiMovement”