Wida You Crooner “Abobi Eddieroll” Wrote; 

“"BREAK THE TABLE"

So for a while ehnn
Some Akpaikpai civilians wey dey feel like say dem don arrive ehnnnnn
Go just dey, buy data,
Charge their phones,
Open Facebook,
No get any better thing to cap
Dem go just carry their frustration put for Bayelsa Artistes

See ehnnn
Dear hypocrites/haters/pompous ass licking fuckboys
UNA NO REACH US LOOK...

First of all, una dey forget say most of una foundation dey for here, 
Most of una, na Bayelsa Radio stations nai first play una songs 
Una dey forget say na Bayelsa OAPS nai grant una interviews for the first time for una stupid lives
Una dey forget say the same 5k dem dey give these boys for this town for show at some point in una miserable lives, una bin dey lobby to get am
Una dey even forget say at some point, una follow for the (BAYELSA ARTISTES) wey una dey curse today...

ABE,
Feel free to Criticize us but no feel free to Insult us

Once person die for this town, All of una go begin post am everywhere make una numerous Followers and fans see the bad news, 
But artiste go drop song 
To post am na issue 

Only Bad news una like to spread..
Then when konji hold una, Na to curse us nai dey cure una craze

As una plenty reach for the lagos.
How many of una don blow for the lagos?
Is it by snapping picture with celebrity
Bitch, I'd rather b a king in the south than be a slave in the west.. 
Abi na d Lagos we never stay before? 
All of us go meet for Top las las
Nothing Gum una sef

And for those of una wey dey feel like Bloggers and Social Media Influencers,
Make una remember say Bad news dey spread like wild fire 

Una work no be to burn down the industry, na to promote the little creativity we have in the Industry..
If u n person get problem..address d person..
No involve us...

If you wan go LAGOS, my brother go o
But abeg try blow first before u begin insult us
Until then 
You be Underground just like the rest of us
Drinking garri in lagos n drinking garri in bayelsa na d same garri

Most of una dey brag about life wey we don live before 
Because you dey for where dem dey act porn no mean say you be pornstar 
U r spectator bitch, Involve for the blue film..
If u know u know 

And Guess what?
I'm a fucking Big Fish..
Dem no dey easily catch my type..

#ABOBIMOVEMENT
#KINGOFTHESTREET
#GETSENSE”