(Verse 1)

Everyday I just dey wonder when man go blow
Cos the road to success is crowded and too slow
E con be like sey na big trailer spoil for the road 
Of the green for the traffic light no dey show
Na all this things dey gimme pains like boy wey get gono
Cos I just wan shine like Banky moromoro
How man go do na to hustle make the blessings begin flow like girl wey dey on her seven days period Yunno
Cos I dan drop dope songs and none of them gbolo
If I begin reason am e fit make me kolo
Baba bless me with hit make my face for show 
Make my fans dance like people wey win lotto
This year I wan make my enemies jogodo like boys wey use tramadol take smoke igbo
Many are called but the chosen ones are few
I pray am among them when the time is dew.


(Verse 2)


One day na one day all eyes will be on me like girl wey wear skirt siddan then open legs 
One day na one day you go dey proud of me 
So if you get butter keep Am cos I dey come with the bread
Life na school every day mehn I dey learn 
I pray sey I graduate well in the end 
Omoh the street no cool strictly boys dey vex 
If you loooseguard 2secs Dem Dan use your head
Big ups to everyone who's been supporting me mehn
I pray sooner or later may we all be blessed 
Right now my pocket be like Phyno.. Too tiny
Baba feed my account make e fat like Teni
Life's boring without the money and the morro when I promise mama still dey pending 
Being an upcoming is really a hard phase
People insult at your back, sometimes face to face 
If you no strong sometimes you fit crash along the way
Even my own parents dey yab me everyday 
But no matter Las Las we go dey okay 
So like the title of my hit song I dey pray for CHANGE.